Abule Egba fire: Car dealer faint afta im 26 cars burn for early mor-mor

Read am in 2 mins

Dem don rush one car dealer go hospital afta im faint wen im reach im shop for Abule Egba dis morning.

Fire wey bin start for early mor-mor burn many things wey include di dealer 26 cars im park for im shop.

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) say di serious fire wey burst out early dis mor-mor dey under control.

Di General Manager for LASEMA, Adesina Tiamiyu tell BBC pidgin say na pipeline vandalization na im cause di fire.

"Wetin happun be say di spill from di vandalize spot travel pass di canal and di drainage enta Abule Egba close to di slaughter for Agege.

"Along di line di tin cause fire wey burn plenti houses, store, cars and oda business," im tok.

Oga Adesina say for now im no fit tok weda pesin die but say some pipo wonjure as dem dey try to run from di fire and jump fence to save dia head.

E say di emergency management paramedics wey dey on ground helep treat some wey wonjure while relatives of odas wey wonjure well-well don rush dem go hospital.

Di LASEMA oga add say di youth from di community give dem good informate and di agencies wen dis kain mata concern go work on di informate to make sure dis kain tin no happun again.

Pipo for social media dey share foto, videos and experience of di fire incident plus tok how di same tin don happun before around dat area.

For 26 December, 2006 pipeline explosion wey happun for Abule Egba kill hundred of pipo as crowds go scoop up petrol wit plastic containers afta vandals go puncture one underground pipeline to tiff fuel.