Jerry Gana: Court say former Information Minister go replace Donald Duke as SDP presidential candidate

Wia dis foto come from, INSTAGRAM/REALDONALDDUKE
One Court for Abuja don declare former Minister of Information, Jerry Gana, as di winner of di presidential primary election for di Social Democratic Party (SDP).
Di party bin announce former govnor of Cross River state, Donald Duke, as di winner of di election and dia presidential flag bearer for di 2019 general election.
According to di party, oga Duke get 812 votes while oga Gana get 611.
But Professor Jerry Gana no gree, im carry di mata go court onto say na im suppose win based on di zoning and rotation formula wey dey inside di party constitution.
For im judgement, Justice Hussein Baba-Yusuf say every member of di party dem must follow di rules wey dey inside di party constitution and must obey am.
Im say zoning and rotation formula dey inside di party constitution wey mean di chairman of di party and di flag bearer no fit come from di same zone.
"For dis mata, di party chairman Chief Olu Falae, na from south and oga Duke too from south; di law dey clear; nothing to tok inside again.
Di Judge, cancel Donald Duke 812 votes and declare Professor Gana di winner of SDP presidential primary election wey dem conduct for October 6 and order di party to forward im name to di Independent National Electoral Commission (INEC) sharp-sharp as di party flag bearer for di 2019 presidential election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im order oga Duke to stop to carry im self as di party flag bearer for di election.
Things to sabi about Jerry Gana
- Jerry Gana na politician and former Minister for Information under Ernest Shonekan and also serve as Minister of Information under President Olusegun Obasanjo
- Professor Jerry Gana na former Geography Lecturer for Ahmadu Bello University, Zaria
- Na senator for 1983
- For 1992 im run but no win to be president under di Social Democratic Party
- Military ruler Ibrahim Babangida goment appoint am chairman of Mass Mobilisation for Social and Economic Recovery
- Founding national secretary of People Democratic Party (PDP) for 1998
- Minister of Co-operation and Integration in Africa under President Olusegun Obasanjo and later Minister of Information
- Im contest to be PDP presidential candidate for 2007 election.










