Anglophone Crisis: Ambazonia separatists dey tell Cameroon President Paul Biya say 289 prisoners freedom na 'big joke'

Paul Biya

Wia dis foto come from, President Paul Biya/@PR_Paul_BIYA

Wetin we call dis foto, President Paul Biya
Read am in 1 mins

Cameroon Defence Minister, Joseph Beti Assomo explain on Friday say 'dangerous terrorists' weh deh di plan and command insecurity crises for Anglophone regions no bi among deh 289 pipo weh president Biya forgive.

Na only de pipo weh deh check dia case fain-fain see say dia crime no big go komot for prison, di minister tok.

But, separatists say de number, 289 Anglophone prisoners, na 'big joke'.

Chris Anu, communication secretary for Southern Cameroons interim goverment for Amba TV say peace go only kam back if goment free all Anglophones weh deh dey for prison for seka de crisis.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tori be say hearing go bi for military court for de five prisons, Bamenda, Bafoussam, Buea, Douala and Yaounde dis December 14, afta dat list for de pipo weh deh go free go komot

For now e bi clear deh number for pipo weh deh go free for each prison.

Bafoussam, 16 pipo, Bamenda 49, Buea 99, Douala, 14, Yaounde central prison, 82, principal prison, 3, Gendarmarie, 33 and two for judicial police.

Biya letter

Wia dis foto come from, President Biya

Since de crisis start for 2016, deh don put plenty Anglophones dem for ngata.

Rights group Central African Human Rights Defenders Network REDHAC bin don komot list for 1000 pipo weh deh dey prison for sea de Anglophone crisis.