You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
2019 elections: Things inside peace accord wey Nigeria presidential candidates sign
Since Tuesday and Wednesday for Nigeria, some candidates wey dey contest di 2019 presidential election don dey Abuja to sign one agreement wey go help prevent katakata, before, during and afta di election.
On Tuesday, President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress bin dey ground to sign im own, while on Wednesday Atiku Abubakar of Peoples Democratic Party (PDP) and Oby Ezekwesili from Allied Congress party show face to sign dia own peace agreement.
Dis na di second time wey organisers dey make presidential candidates sign di agreement, and oga Abubakar say make all di candidates ensure say dem promote peace and violence free election. Former Nigerian military ruler Abdulsalami Abubakar na im be di chairmo of di committee wey dey organise di signing.
Wetin di agreement tok.
For dis peace agreement, dem want make di candidates avoid hate speech, fake news or any action wey fit cause palava for di kontri.
According to wetin dey di document, di candidate, dia political party plus agents:
- Go run campaigns wey go dey based on particular mata wey dey worry di kontri and promise not to do campaigns wey dem go dey attack religion, tribe or ethnic group
- Go avoid statements, announcements, declaration or tok-tok wey fit cause kasala before, during and afta di elections
- Go dey loyal and cooperate wit di National Peace Committee - wey be respected statesmen and women, traditional and religious leaders- wey dey monitor to make sure say everibody obey di agreement
- Go support all di institutions of goment including INEC and security agencies to take action and see dem as pipo wey no dey do pacha or ojoro
- Go speak out for public and no keep quiet for tok/statement wey dey provoke pipo and dey against any kind of electoral violence, weda na dia supporters or opponents do am.
As e be so, no be all of di presidential candidates don sign di peace agreement but dem still dey expect dem to sign am.