Peter Obi office don confam say PDP VP candidate bank account don freeze, but dem no know who block am

Wia dis foto come from, AFP
Di personal assistant to PDP vice presidential candidate, Valentine Obienyem dons tok say true-true dem freeze im oga account.
Val Obienyem tell BBC Igbo say dem neva find out pipo wey order am but dem go try find out during di week.
"But if federal goment come out tok anytin, we no dey fear because my oga na man of integrity, im hand dey clean."
"Until dem tok, we go no wetin to do next."
Meanwhile, Nigeria main opposition peoples democratic party on Saturday night claim say di kontri corruption police EFCC don freeze all di bank accounts wey belong to dia party Vice-Presidential candidate and im family.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
But di Economic & Financial Crimes Commission say dia hand and leg no dey inside dat mata.
Peoples Democratic Party don condemn di freezing of all bank accounts wey belong to dia Vice-Presidential candidate, Peter Obi, im wife & family members and dia business dem.
Tok-tok pesin for di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC),Tony Orilade say di agency hand and leg no dey inside di mata, according to tori pipo Channels TV.
End of Di one wey oda users dey read well well
For di statement wey PDP tok tok pesin Kola Ologbondiyan carry come out, e claim say since Peter Obi become dia vice-presidential candidate, na so so threat e dey get.
E include threat to im life and those of im wife and pikin.













