How PDP use fake foto to shame President Buhari ontop Boko Haram wahala

Wia dis foto come from, Other
Before President Muhammadu Buhari enta power for 2015, one of im main campaign promise na to end Boko Haram.
Buhari wey be retired military General, bin say im go "lead from di front" to deal wit Boko Haram.
Three years wey im don do as President and as e be like say di Boko Haram katakata still get as e be, im opponents don begin use di blood and tears wey di militants still dey cause as political weapon.

Wia dis foto come from, Getty Images
E take oga Buhari almost one week to react to di mata wey dey ground now, wia many Nigerian sojas die for Boko Haram hand, even afta di tori don circulate well well all over.
Tori comot say na 44 soldiers die inside di latest attack by Boko Haram ontop Nigeria soldiers for Metele village, northeastern state of Borno last week Sunday, but wen di Nigeria Army demsef enta social media to give reason why e take dem 5 days to confam di attack, dem no tok pim on di number of soldiers wey lose dia life.
E no dey clear why di Nigeria Army no tell di public how many soldiers die and e be like e give some pipo mind to begin spread rumour and fake news about di mata.

Wia dis foto come from, Getty Images
Sabi pipo say na wetin di goment opposition dey do now be dat, dis one wey di 2019 election don dey near because dem know say security na big mata for Nigerians.
Main opposition to Buhari administration, di Peoples Democratic Party (PDP) no waste time to post dia own reaction to di Boko Haram attack wit fake foto wey show plenti deadi bodi of soldiers from anoda kontri for Africa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

Even one US-based journalism professor become victim afta im go post foto of Nigeria soldiers wey im tink say dey involved for di Boko Haram ambush.
Di fact be say di foto na from one Kannywood feem Abu Hassan, wey dey try tell di tori of famous Nigerian soja, Col Abu Ali wey don die.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
For inside statement wey dem release for social media, di Nigerian army don threaten to sue anybody or organisation wey join spread fake tori, video and pikshure of Boko Haram attack on military.
Dem say dem no happy wit di way video full everiwia wey claim to show di attack on soldiers for Metele, Borno state, di army tok on Sunday, 25 November.