You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Seven storey building don collapse for Port Harcourt
One seven storey building wey still dey under construction don collapse for Woji road for New GRA for Port Harcourt, capital of Rivers state, south south Nigeria.
Pipo wey see say di building collapse happun around 5pm dis evening and many workers and petty traders still trap inside.
As at 8pm on friday, dem don free 21 pipo wey trap, and dem dey receive treatment for hospital.
Medical workers, fire service, Red Cross and security pipo dey ground dey try rescue more pipo wey still trap for under.