Buhari: APC don disown 'Next Level' logo wey dey cause wahala

APC presidential campaign logo

Wia dis foto come from, Buhari 2019 Campaign

Read am in 2 mins

Di 'Next Level' logo wey President Muhammdu Buhari launch for im 2019 re-election campaign dey provoke pipo wey believesay dem tiff logo wey dem use launch dia campaign.

Tori full social media on Tuesday say Nigeria ruling All Progressive Congress - APC party use copy-copy tiff dia #NextLevel logo from di one wey America institute, Rex Institute use for dia website

"Na enemies of progress" dey spread rumour upandan say we tiff logo wey dem use launch dia campaign"

Festus Keyamo, SAN wey be President Buhari 2019 Presidential Campaign tok tok pesin na im tell BBC Pidgin dis one.

Di presidency twitter handle bin tweet pishure of dia policy say dem dey go di "next level" wey be im plan for 2019 elections.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Tori be say rumour upandan say dem tiff logo wey dem use launch dia Next Level campaign.

Wia dis foto come from, Other

Oga Keyamo say di logo wey pipo dey bad mout APC wit, "na opposition party make adaptation of dia logo."

"We no tiff anibodi identity and supporters dey free to make any logo dem want, di logo wey we use na di logo wey dey our policy document."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Im still add say di logo wey dey di APC document na dia clear difference dey as "di APC own no get arrow for di V part".

"Anibodi fit do any logo online," na so oga Festus Keyamo, SAN tok.