You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nnamdi Kanu: Court order Senator Abaribe and odas wey bail Biafra leader to pay N100m each
Federal High Court for Abuja don tell di pipo wey stand sureties for Nnamdi Kanu wey include Senator Eyinnaya Abaribe to pay 100 million naira each say dem no fit produce di Biafra activist for court.
Local tori pipo tok say Justice Binta Nyako wey give di order as new ruling for im bail, give di four men two months to transfer di money for enta di court account.
Pesin from Senator Abaribe office tell BBC say di judge order say make dem transfer di 100 million naira bail money from Nigeria Treasury Single Account wia dem bin hold am, enta di court account on Wednesday.
But pesin wey dey inside di court tell BBC say wetin di judge tok na say make dem deposit dia bail bonds of N100m within two months to di court registrar.
So as e be so, di bond money neva leave Senator Abaribe and di oda sureties accounts.
Dis dey come afta Nnamdi Kanu make appearance for social media.
Di case don dey adjourned to 28 March 2019.