Cameroon school kidnap: 'Di kidnappers hit some pikin dem wit guns' - Pikin wey escape

School children

One pikin wey manage escape di kidnap for Bamenda, northwest Cameroon don tell BBC how im take dodge di kidnappers.

Di student say na under bed im go hide wen di kidnappers show for im school.

"Di kidnappers hit some students wit dia guns. Dem say dem dey suffer, dey sleep on top grass and our parents dey send us go school," di student tok.

BBC find out say na 79 pikins, principal, two teachers plus driver na im dem kidnap for Presbyterian Secondary School on Monday November 5 for Bamenda.

Eric Tataw wey be journalist for Bamenda tell BBC say di kidnappers go don use correct transport system to kolobi 82 pipo for night because of di curfew wey dey di city.

"We neva see dis kain kidnap for Bamenda before," Tataw tok.

Cameroon authorities di chakarah place for look for de 79 PSS Nkwen pikin dem weh gunmen kidnap for Northwest region but separatist and goment di accuse one anoda for de kidnap.

Map of Bamenda.
Wetin we call dis foto, Di school dey Bamenda for northwest Cameroon

But afta dis kidnap, separatist don komot release for say na goment make de drama for kidnap for distract attention.

Movement for de Restoration of the Independence of Southern Cameroon, Morisc accuse goment say na dem stage manage de kidnap. Also, de interim goment of Southern Cameroons accuse goment say na deh dey behind de kidnap.

Goment too say na separatist kidnap de pikin dem as deh say make all school dem remain close until goment answer dem.

African People Liberation Movement and Southern Cameroon Defense Forces, say make de kidnappers free de pikin dem because na criminal act and say deh di helep human rights for ground look for de pikin dem.

But even now de number for de pikin dem weh deh kidnap nova be clear, activist say na 81 pikin dem but goment say na 79.

"UNICEF di condemn dis kidnap strong-strong and call say make de free de pikin dem now-now without any condition", director for west and central Africa, Marie Pierre Poirier tok.

De kidnap happen just as President Biya di take oath for rule kontri for de next seven years and for make sure say security tight for town e declare public holiday.