You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
10 African kontris wey dia goment worst pass
Mo Ibrahim Foundation on Monday release list of di 10 kontris wey get di worst goment of kontris for Africa.
Di areas wey di foundation torchlight to do di ranking na Safety and Rule of Law, participation and human rights, sustainable economic opportunity and human development.
Top of di list na Somalia wey rank 54 out of 54.
Di MO Ibrahim foundation rank Nigeria 33 out of all di 54 African kontris with score of 47.9 for overall governance. But Nigeria still try small as di kontri increase from 35 for 2017 to 33 for 2018.
Di kontri wey get di best governance for Africa according to di foundation na Mauritius with overall score of 79.5.
Di Mo Ibrahim Foundation dey torchlight leadership and governance for Africa.
Dis IIAG na di yearly report wey dem dey use check how governance be for African kontris.