TEF: See as Cashmadam Mahassin Quadri win N1.8million Tony Elumelu money

Di event wey dey happun evri year dey gada business pipo from all over Africa.

Mahassin Quadri
Wetin we call dis foto, Na five oda business pipo follow Mahassin Quadri drag di $5,000 prize
TEF 2018 Entrepreneurship Forum
Wetin we call dis foto, Mahassin wey come from Nigeria win over oda pipo wey come from Madagascar, Mauritius and Tanzania
Mahassin Quadri dey tok
Wetin we call dis foto, Quadri bin don already collect $5,000 for her CashMadam app and now she don get $5,000 join to take upgrade and carri di app far.
Tony Elumelu and Nana Akufo-Addo
Wetin we call dis foto, Ghana president Nana Akufo-Addo show for Nigeria to attend di event.
Mahassin Quadri dey collect award
Wetin we call dis foto, Mahassin beat 4 oda pipo to carri first prize.
TEF 2018 Entrepreneurship Forum
Wetin we call dis foto, Dis entrepreneur get one product wey be handbag for women wey fit charge phone.
Solar bag for women
Wetin we call dis foto, Di bag dey use solar panel to take draw power from di sun and e no too cost
Big-big pipo wey come di event
Wetin we call dis foto, Ghana president say na Africa suppose dey borrow oda kontris money, no be say continent go dey collect.
TEF 2018 Entrepreneurship Forum
Wetin we call dis foto, Plenti young pipo from all over Africa come for di event - many of dem na business owners dem be.
TEF 2018 Entrepreneurship Forum
Wetin we call dis foto, Tony Elumelu Foundation say dem wan use $100m support 10,0000 young business owners for Africa before year 2040.
TEF 2018 Entrepreneurship Forum
Wetin we call dis foto, Dem use hashtag #TEFFORUM2018 for pipo to take connect for social media.
TEF 2018 Entrepreneurship Forum
Wetin we call dis foto, Africa na one of di continents wey get young pipo pass for di world
Oluchi
Wetin we call dis foto, Super Model Oluchi na one of di judges wey come for di event.
Dr. Awele Elumelu
Wetin we call dis foto, Dr. Awele Elumelu tok about why healthcare need to improve well-well for di kontri.