Stella Adadevoh: Google Doodle dey celebrate Nigerian doctor wey fight Ebola

Wia dis foto come from, Google
Dr Stella Adadevoh for celebrate 62 years birthday today if to say she dey alive and Google dey use dia Doodle to troway twale give di Nigerian doctor.
E don reach four years now wey Dr Adadevoh die afta she epp her kontri fight Ebola.
Na she make sure say Liberian diplomat, Patrick Sawyer, no go anywia afta dem confam say e get Ebola so e no go spread am give oda pipo.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Liberian goment bin give Dr Adadevoh serious pressure dat time, sotay di Liberian Ambassador dey accuse say weda na kidnap di hospital bin kidnap dia man.
Later she sef and eleven of her co-workers follow catch di virus and she die for August 19 2014.

Dr Adadevoh before she die don dey work as Endocrinologist for di First Consultant Hospital for 21 years.
Afta she die she collect plenti accolades, plus including di 93 Days film wey dem do to celebrate her.









