Usman Yusuf: NHIS oga say health management companies dey use pipo moni do magomago

    • Author, Dooshima Abu
    • Role, BBC News Pidgin, Abuja

Prof. Usman Yusuf wey be di Executive Secretary of di National Health Insurance Scheme - NHIS, don accuse Health Management Organisations HMOs, say dem dey use pipo moni do magomago.

Prof Yusuf dey face kwanta for di NHIS office for Abuja, and on Monday, im own staff lock gate make im no enta.

Wen im follow BBC Pidgin tok, im say na pipo wey no want make im expose di wuruwuru wey dey go on wit HMOs, dey fight am.

"Many of di HMOs no get licence I come decide say make dem renew am and dem must collect letter from all di hospitals wey dem dey serve and out of dey 57 of dem only few make am," im tok.

Yusuf explain give say since 13 years wey dem create NHIS, di HMOs go collect plenti moni and instead of wey dem go pay hospital make dem give quality health care to pipo, dem go fix di moni for bank, take loans wit di moni or buy foreign exchange to maximise dia profit.

Oga Yusuf still add say di govning council no get right to suspend am because di constitution no give dem dat kain authority.

'No be all HMOs dey owe health provider'

One HMO operator don comot say no be all of dem wey be health maintenance pipo dey owe hospital moni.

Di operator wey no want make BBC mention im name, say di katakata wey dey happun for di agency na about power tussle.

"Some HMO good and dem di pay di hospitals but odas no good and e no good make im generalise like dat," im tok.

'E dey for di regulator hand to weed those wey no good out," im explain.

Earlier, Garba Shehu wey be media aide to Nigeria President Muhammadu Buhari, say di wahala wey dey happun for di kontri National Health Insurance Scheme - NHIS don dey take ethnic and political waka.

Oga Shehu say e be like say some interest groups for outside and inside di agency wan remove di NHIS boss Usman Yusuf by force because of di reform wey e dey bring for di organisation.

E explain give say before, di Health Management Organisations - HMOs dey collect five billion naira everi month and dem just dey share am until NHIS oga land come dey stop am and now na only 1.3 billion dem dey get.

E say as tins be now, di NHIS govning council no follow due process to suspend di NHIS boss.

E explain give say di Secretary to di Goment of di Federation plus Minister of health don dey chook mouth for di crisis to ensure say dem find solution.

Wen BBC Pidgin call di Ministry of Health, dem say di minister Isaac Adewole just come back from Brazil and still dey get briefing on top di mata before e go comment.