Five tins to sabi about Norway wey wan increase visa dem dey give Nigerians

Norway Ambassador to Nigeria, Ambassador Jens-Petter Kjemprud, say di embassy get plan to increase di number of visa to Nigerians.

Kjemprud tell local tori pipo News Agency of Nigeria say di embassy go soon start to discuss di mata with VFS Global and di Nigeria-Norway Chambers of Commerce.

Oga Kjemprud say di number of visas wey dem dey give Nigerians dey too small.

"We wan make Nigerians do more with Norwegians for future. But we know say di visa wey we dey give Nigerians dey too small.

"Di embassy dey plan to discuss with VFS Global and di Nigerian-Norwegian Chamber of Commerce to increase di number of visas to Nigerians very soon,' na wetin im add put.

Kjemprud say out of 600 visa applications wey di embassy receive from Nigeria between January and August dis year, only 290 get visa.

Five things you suppose know about Norway before you travel

Norway na Scandinavian kontri

Norway, Denmark and Sweden follow for those wey dem dey call Scandinavian kontris. History be say all of dem from di same area come out. Norway get population of about 5.2 million pipo.

Norwegian currency na NOK (Norwegian Krone)

Di official currency for Norway na Norwegian Krone. So if you dey travel with only Euro you go get wahala.

Plenty Norwegians dey speak English

Even though dia main language na Norwegian, many Norwegians sabi speak English. So no fear if you dey visit for di first time and you know sabi speak dia language.

Carri extra cloth

Weather sabi change well- well for Norway, di kontri get four seasons: winter, spring, summer, and fall. Make sure say if you dey travel go di kontri you carri plenty clothes and follow di weather report so cold no go finish.

Norway dey very safe

Norway na one of di safest kontris for di world. Crime rates for di major cities like Oslo, Bergen, Trondheim, and Stavanger dey very low.