Shehu Sani: Govnors for Nigeria get power pass President Buhari

Senator Shehu Sani
Read am in 2 mins

Popular Nigerian senator, Shehu Sani, don accuse govnors for di kontri say dem don turn di ruling party upside down.

Mr Sani announce say e don port comot All Progressives Congress,APC, afta di party no gree allow am contest for im post again.

E say oda parties full ground brekete wey go give am chance to represent im pipo for senate.

Many local tori pipo like Premium Times, Daily Trust, TheCable dey carri news on Saturday say di lawmaker don send resignation letter give APC chairman, Adams Oshiomhole.

In fact, sombori post wetin dem say be di letter wey im sama im party to say bye-bye.

Mr Sani say na govnors dey control evritin for di party and na dem dey control President Muhammadu Buhari.

E say APC don change dia way and no dey follow wetin dem promise di pipo again.

Shehu Sani

Wia dis foto come from, Senator Shehu Sani/Instagram

Wetin we call dis foto, Oga Sani promise say im go re-contest for senate under anoda party

Plenti roforofo fight happun for APC primaries all ova Nigeria, plus including di one wey oga Sani contest inside for im state Kaduna.

Tori be say na di lawmaker wey di party choose for next year election inside Kanduna central senatorial district but Kaduna govnor, Nasir el-Rufai no gree, according to im camp.

Governor Nasiru el-Rufai of Kaduna state.

Wia dis foto come from, Kaduna Government/Twitter

Wetin we call dis foto, Oga el-Rufai and oga Sani no dey see eye-to-eye for Kaduna state

Oga Sani bin fashi di primary, come file appeal against di result.

Di party bin support im appeal but di candidate name wey dem forward give election body INEC na di pesin wey oga el-Rufai support.