You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Islamic State: Time dey run out for IS to kill dis two Nigerian health workers - ICRC
International Committee of di Red Cross (ICRC) send warning give Nigeria goment on Sunday say di Islamic state fit kill two healthcare workers wey dem don kidnap since March 2018.
Hauwa Mohammed Liman and Alice Loksha bin dey work for di town of Rann, Borno State northeast Nigeria as medical workers wen dem kidnap dem.
For inside statement ICRC say make di Federal goment use "speed" to negotiate di release of di health workers from di armed group wey also hold 15-years old Leah Sharibu.
Red Cross also release video on Sunday afternoon to beg for Hauwa and Alice freedom.
Di armed group bin don kill midwife, Saifura Hussaini Ahmed Khorsa wey dem bin follow kidnap wit di two midwife and ICRC say dem promise to kill di remaining two within 24 hours.
So far, no report don comot weda di militant want any ransom for di two health workers.
Patricia Danzi wey be di director of ICRC tok say "di two women wey be nurse and midwife no dey part of any fight."
Before dia kidnap, Liman bin dey work as midwife for ICRC-support hospital while Loksha na nurse for UNICEF.
End of Di one wey oda users dey read well well