Accra Mall ceiling collapse for shoppers head

Read am in 1 mins

Ghana Presido Nana Akufo-Addo on Friday say di accident for Accra Mall ceiling wey collapse for shoppers head dey disturbed am.

Tori be say, three pipo wunjure wen part of di ceiling of di mall fall down Thursday morning as pipo dey shop inside di mall.

Now, presido Akufo-Addo dey beg Ghana pipo to improve maintenance culture.

Di president for tweet as im dey react to wetin happun also pray for di pipo wey wound to get well quick.

Accra Mall na shopping center inside Accra, wey ddey for Spintex road just opposite Tema Motorway.

Na July 4, 2008 dem commission di mall wey suppose be one of di most modern shopping malls inside West Africa and the first large-scale shopping centre for Ghana.