Police arrest masquerade wey stab pesin die

Ondo police na im gbab di masqurade

Wia dis foto come from, Princess Williams

Wetin we call dis foto, Ondo police na im gbab di masqurade

Police don arrest one masquerade and one of im followers wey dem accuse say go stab one 30-year-old man die sake of di man no gree give dem money.

Police Commissioner Olugbenga Adeyanju, wey confam di arrest give tori pipo say di masquerade and im follower wey be 75 year-old chook one 30 years old Femi Makanjuola die during one festival.

Di festival happun for Akure, Ondo State southwest Nigeria

Police inside Ondo State say na di elder brother of di man wey di masquerade stab Seun Makanjuola, come report di mata for dia 'B' Division Station police station AKURE.

Masquarade

Wia dis foto come from, iStock

"We arrest di masquerder wey e name na Olu Olowokere, and one Adaramola Ajuloko while one Deji Dada of Jeje Street, Danjuma and Sunday Adaramola of Olorunsogo Street, Gaga,Akure run away." Oga Adeyanju, di police commissioner tok say dem go soon carry di masquerade go court afta dem don complete dia investigation on top di mata.

Meanwhile, di police tok-tok pesin for Ondo State, Femi Joseph tell BBC say masquerade parade suppose entertain pipo and pray for di citizen during dia festivals but most pipo wey dey decorate demsef as masquerades dey take hard drugs and drink plenty alcohol during dia festivals.

Oga Joseph advise youths say make dem dey always obey di law.