Police don gbab two men wey tiff deadi bodi from mortuary, demand N4m ransom

Wia dis foto come from, Getty Images
Police for inside Imo state - southeast Nigeria confam Friday say dem don arrest two men wey go tiff di deadi bodi of one old woman inside Owerri.
Police say di two men wey tiff di deadi bodi from one hospital mortuary, carry am enta inside bush and begin disturb di family plus di hospital wey get di mortuary to pay dem ransom of N4m before dem go release di body back to dem.
Andrew Enwerem di Police Public Relations Officer inside di state, tell BBC Igbo say wen di kidnappers begin worry di family upandan for money, dem come report di mata give police wey come lead to dia arrest.
E say di two suspect na ex-convicts wey dem just free from prison afta dem don serve 6 years and 14 years for jail on top kidnapping charges.

Wia dis foto come from, Getty Images
Oga Andrew say police don return back di deadi body give di family for dem to continue wit dia burial plans wey dem bin dey make before di kidnappers go tiff di body from mortuary.
Report say di old woman wey dem tiff her dead body no be rich pesin and even di family no dey rich too.







