You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wizkid Day: Why pipo dey para
One of di big tori wey dey trend for Nigeria social media na how Minnesota, one state for United States, don declare October 6 as Wizkid Day.
According to tweets and some video wey some pipo do, dem sama di Nigeria Afrobeat star di special accolade afta e perform for Skyway Theatre for di state.
Di Minnesota goment neva chook mouth for di mata, even though di photo of di declaration don land for Twitter.
E be like say di paper get di seal of di state and signature of di govnor, Mark Dayton.
BBC Pidgin neva confirm weda, true-true, Minnesota don give Wizkid im own day.
Local tori pipo don dey report di tori sha.
And as usual, Nigerians no dey carri last for dis kain tin.