Labour Unions for Nigeria don suspend dia strike

Labour Congress

Wia dis foto come from, STRINGER

Nigeria Labour Congress and Trade Union Congress don suspend dia warning strike onto minimum wage mata.

Na on Sunday dem call off di strike, say na to confam say dem receive letter fron federal goment to call di Minimum wage Tripartite meeting on di 4th & 5th of October.

Na on Thursday dem bin start di strike wey dem say go last until thy-kingdom-come, but na only two days e last.

labour bin start di strike afta di 14-day ultimatum wey dem give federal goment to tok how much dem wan pay as new minimum wage, expire.

Di three labour unions dey demand N65,500 as new minimum wage for workers, while di private employers and some state govnors say na N25,000 dem fit pay.

Wetin we call dis Video, NLC nationwide strike no allow us marry