Paul Biya dey Maroua for e first campaign meeting

Paul Biya, candidate for October 7, 2018 elections dey Maorua, Far North region today de first taim since weh de official launch campaign for September 22.
Na for night for e twitter account weh Paul Biya write say e and e woman, Chantal Biya di go campaign for Maroua. Before dis official campaign, na oda party mimbas dei campaign for Paul Biya.
Biya weh e di stand again as candidate don already bi 86 years, 36 as president wen kontris laik Nigeria don already change eight presidents.
Among de pipo weh deh di campaign for Biya na for President Amadou Ahidjo e pikin, Aminatou Ahidjo, all ministers, directors and odas.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Even before official campaign, deh launch book weh e get e programme for different part for kontri.
Na so campaign poster full every-where for town and, deh di share wrapper and school bags, and four podium motor dem with Paul Biya e picture.

About 40,000 youths dem, bensikin riders, buyam-sellam dem komot for Yaoundé go march say Paul Biya na dia own candidate.
Afta Maroua kontri pipo dem di wait for see Paul Biya go odas part for kontri laik Bamenda, and Buea weh fighting don stop all kain election campaign.
End of Di one wey oda users dey read well well
Only Akere Muna try for campaign for Limbe but e no bi stay long for de kain insecurity as e be bi na for de day weh deh kill seven pipo dem for Buea.
Odas candidates too di continue dia own campaign for different parts for kontri, Franklin Ndifor Afanwi for Cameroon national Citizen Movement, CNCM dey for Ebolowa today, and Maurice kamto Cameroon Renaissance Movement, CRM for Yaoundé tomorrow.












