Authorities di search Wum, NW Cameroon for 70 prisoners weh separatist forces free

Authorities for Wum don start di search for about 70 prisoners weh separatist force free afta deh attack prison today.
Na for Sum, Ukwa, Weh and oda villages dem near Wum weh goment force di search for de prisoners we deh run.
Afta shooting weh e take hours for stop for Wum prison, about 70 prisoners don runaway.
Eye-witness say deh shoot de man weh e start comandier de attack, but say e kombi dem take e run with'am.
Dis attack and free prisoners for Wum na number three afta de wan for Ngoketundjia for Ndop weh separatist forces bin attack de prison, some prisoners run, odas kam back for prison.
Since weh palapala start for Cameroon, for 2016, tension dis so-so high for English speaking regions dem for Northwest and Southwest.
Tori na how kontri pipo di suffer violence for army and separatist forces dia hand.







