You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa go make am easy again for foreigners to get visa
South Africa say go relax dia tight travel visa rule wey dem believe say don damage di kontri tourism industry.
Di goment - wey dey find way to ginger back dia economy - say foreign families no go need to go find dia pikin birth certificate come.
Home affairs minister Malusi Gigab say di changes go happun before di December holidays.
For di past four years, tourist don dey struggle to enta South Africa because of blockade everywia for di application process.
And na di same tin for South African families wey wan travel abroad.
You go hear tins like passports no reach (for pipo wey wan get), pikin wey need to get birth certificate and say make pikin must bring letter from im two parents wia dem don write say dia pikin wan travel.
Di authorities say dem dey do all of dis to fight child trafficking. But di informate wey dia decision dey based on dey one kain, and even di travel and tourism industry say di rules sef dey affect jobs and business profit.
Now, as di economy dey enta recession small small, South Africa new President Cyril Ramaphosa, don order say make dem tink di whole arrangement again so as to ginger tourism.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis mean say more visa on arrival go dey. Online applications. Blockade for tourist from China and India no go dey.
And, families wey dem dey send back because one paper no correct, go reduce well well.