You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria flood 2018: Dis year flood fit tie wrapper pass di wan wey happun for 2012 - NEMA
Di National Emergency Management Authority - NEMA, wey dey in charge of emergency situations for Nigeria, say di flood wey dey happun dis year for di kontri fit bad pass di one wey happun for 2012.
Oga for Media and Public Relations mata for NEMA, Sani Datti na im tell BBC Pidgin dis one.
"All di sign from di Nigeria Hydrological Services Agency and odas wey dey give us di prediction don point say di water dey even high pass di one wey happun for 2012," im tok.
Oga Datti tell BBC Pidgin say wetin dey cause dis flood-flood wey dey happun for Nigeria na climate change and di way wey pipo dey build house for flood prone areas.
Though flood na sometin wey dey happun almost everi year for some parts of Nigeria, di one wey happun for 2012 na im don worse pass.
According to NEMA, di 2012 flood affect 32 out 36 states and e pass 300 pipo wey die. Millions of pipo na im run scata from dia house.
"One tin pipo need to sabi be say climate change and di way some pipo dey build dia house for flood prone area dey contribute to flooding.
"Climate change na serious issue, and e depend on di intensity of di rate, wey go fit make am affect flooding. Dis year di rain plenty, e dey intense," e tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Datti add say wetin make dis year flooding neva worst pass as e dey now be say Cameroon authorities neva release dia Lagdo Dam and dat na why goment even don declare national disaster because dem need to begin cari pipo comot from flood prone areas before e happun.
"Wit di way wey di rain dey fall well-well, Cameroon no get any option dan to release di dam. But di good tin be say Nigeria already don sign agreement wit Cameroon to inform us first like 48 hours to di time before dem release am. "
Nigeria bin don declare national disaster for four states - Kogi, Delta, Anambra and Niger and still dey torchlight eight oda states - Taraba Adamawa, Kebbi, Edo, Rivers, Benue, Bayelsa and Kwara states.
Before now di Acting Director-General of Nigeria Hydrological Services Agency (NIHSA), Ahmed Mabudi bin say di water level for di Lagdo dam na 12.1m, so e need to get to 12.6m before dem start any release.