Linda Ikeji don born boy pikin

Wia dis foto come from, @officiallindaikeji
Nigerian ogbonge news blogger, writer, business woman and former model Linda Ikeji don born baby boy.
Linda wey travel go obodo oyibo America go born her pikin announce di birth of her first pikin for inside her Instagram post dis morning.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di new mama no waste time to let evri bodi know di name of her tear rubber pikin na Baby J since last week.
Ikeji, wey be Nigeria richest blogger, bin do baby shower last weekend for America as she dey wait for Baby J to show,
Psquare Peter Okoye, Linda sister Laura Ikeji Kanu and her husband dey among di pipo wey gbadun di party.








