E no true say dem 'tiff' two aeroplanes for Lagos airport - NCAA

Sam Adurogboye wey be tok tok pesin for di Nigerian Civil Aviation Authority don tell BBC Pidgin e no true dem tiff two planes for Lagos Airport.

Adurogboye dey answer back claim say two aeroplanes wey one Nigeria operator, Topbrass Aviation Services Limited, bin dey use for work before, don fall victim of 'suspected tiff tiff' for Lagos airport.

Some tori pipo bi report say one pilot for Nigeria presidential air team don cari di plane for wia dem keep am for di General Aviation Terminal for Murtala Muhammed Airport (MMA) go Aero Contractors' Maintenance and Overhaul (AMO) wey goment dey control. But oga Adurogboye say, ''di aeroplane dem dey for ground for Lagos, south west Nigeria''.

Im say: ''Aeroplane no be toy pesin fit keep inside travelling bag come cari run, dem no fit tiff am. Aeroplane fit move but na afta e don get green light from di correct authorities.

''Our work as regulator for aviation na to helep evribodi so e no follow say we fit dey involve on top dis kain mata but di mata dey court and afta Topbrass Aviation Services cari court case come, so NCAA go meet di dem for court'' na so Adurogboye tok.''

How di wahala first start

Di two 50-seater Bombardier Dash 8 Q300 aeroplanes don cause fight fight for court between di landlord of di plane - Seagold Investment Limited and Topbrass Aviation Services.

Na Seagold Investment Limited bin cari di planes come for 2005 and dem sign deal wit Topbrass wey dey operate offshore waka for Chevron for Nigeria. Topbrass pay $12 million for 30-month hire purchase agreement.

But dem fight afta Seagold Investment do u-turn wan collect di plane for Topbrass hand so dem cari di mata go court for 2015.

According to Di Guardian tori paper, di mata enta cloud nine afta some pipo for presidency bin seize di aeroplane come cari dem comot and change dia registration package even though Federal High Court for Lagos don already say make nobody touch di planes.

Topbrass dey claim say instead make NCAA as regulator to do referee dem dey do partial for goment, dem ignore court order, give all di paper for di plane put for di hand of di presidential air team.

Guardian still claim say e be like dem wan cari di planes travel comot for Nigeria but e no sure wia.