UN 2018 Human Development Index: Ghana, Cameroon beta pass Nigeria

Burundi protest.

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigeria life expectancy on Saturday increase by eight years, but Ghana and Cameroon condition beta pass according to United Nations Development Programme 2018 report.

Di latest report wey show Human Development Index (HDI) for 189 kontris all ova di world put di number of years pesin fit live life inside Nigeria for 53.9 years, Cameroon 58.6 years and Ghana 63 years.

UNDP 2018 Development report measure how kontris don perform for health, education, standard of living and moni wey pipo dey make to get di new statistics.

Nigeria ranking drop by one point from 156 to 157 under Zimbabwe wey carri 156 out of di 189 rankings.

President of Nigeria, Muhammadu Buhari.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari bin promise change for life to beta wen e become Nigeria presido for 2015

Dis one mean say Nigeria fall under those wey get low human development for 2018 report.

Cameroon and Ghana fall under kontris wey get Medium Human Development according to dis latest UN report.

Cameroon upon di Anglophone palava rank 151 while Ghana rank 140.

A woman tending to a new-born baby
Wetin we call dis foto, One pikin dem born ontop mat for Nigeria

Oda informate wey dey inside di UNDP report be say di number of years wey kontri pipo dey spend for school don increase by one year for Nigeria and di kontri Gross National Income (GNI) don also increase by 87.4 percent.

Norway na im rank number one for human development inside di report and di number of years pesin fit live life inside Norway na 82.3 years.