Forbes ranking: JAY-Z & Diddy na Highest-Paid Hip-Hop artist 2018

American rapper JAY-Z na im be di world highest-paid hip-hop acts 2018, according to Forbes Magazine latest list.

JAY-Z win wit income of $76.5 million wey im get through e record label, Roc Nation, TIDAL, plus di tour wey im do afta e release im album 4.44, plus di Everything Is Love album wey e do wit im wife, Beyonce, and di stadium tour wey dey go on now wey dem call On The Run II, plus odas.

Sean "Diddy" Combs, carry number two position wit $64 million wey im get from im beverage business like, Ciroc Vodka, DeLeon tequila and Aquahydrate alkaline water.

Kendrick Lamar tanda for number 3 spot wit $58 million from im endorsement deals wit Nike and American Express for im 'DAMN' tour.

Drake dey number 4 wit $47 million while J. Cole enta number 5 position wit $35.5 million and Dr. Dre plus Nas dey number 6 spot togeda wit $35 million.

Oda wey dey di list na, DJ Khaled, Future, Eminem and Migos.

See Di Top 10

The top 10 artists are as follows:

1. JAY-Z — $76.5 million

2. Diddy — $64 million

3. Kendrick Lamar — $58 million

4. Drake — $47 million

5. J. Cole — $35.5 million

6. Dr. Dre — $35 million (di same)

7. Nas — $35 million (di same)

8. Pitbull — $32 million

9. Future — $30 million

10. Kanye West — $27.5 million

11. DJ Khaled ($27 million)

12. Migos ($24.5 million)

13. Eminem ($23 million)

14. Chance the Rapper ($21.5 million)

15. Travis Scott ($21 million)

16. Birdman ($20 million)

17. Lil Uzi Vert ($19.5 million)

18. Lil Wayne ($19 million)

19. Logic ($17 million)

20. Meek Mill ($15 million), Russ ($15 million), and Swizz Beatz ($15 million) all dey di same position.