You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Boko Haram: Wetin dey happun to Leah Sharibu, 200 hundred days inside militants hand
#Freeleah trend on Thursday all over di world for social media sake of 200 days don waka pass since Boko Haram katakata group kidnap Leah Sharibu from one school for Yobe, northeast Nigeria.
Leah na di only Christian school pikin wey follow for more than 110 girls wey Boko Haram militants kolobi on 19 February, 2018 wen dem attack Government Girls Secondary School Dapchi, Yobe state.
Boko Haram free di oda schoolgirls for March 2018 afta goment negotiation, but dem no release Leah.
On Tuesday, one British lawmaker Tom Brake go sidon outside Nigeria High Commission for UK to launch 200 hours for 200 days protest to free Leah.
Tori be say, di reason di militant group no gree release Leah na sake of say she no gree change her faith from christian to muslim.
Di trend for social media na for Boko Haram to sharperly free her and for Presido Mahammadu Buhari to act now now.
Wen BBC News Pidgin tok to Femi Adesina wey be President Buhari Special Adviser on Media and Publicity to know wetin goment dey do about di mata, im no gree tok anitin as im feel say "di tin na security mata."
Her papa Nathan Sharibu bin tell BBC News Pidgin for August say "im still get hope say im go see im pikin face one day."
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Sharibu say since wen im pikin loss reach now, im neva hear pim from goment or any yarns about di release of im pikin from anybody wey fit dey arrange her release.