Bukola Saraki wan pursue Buhari comot as Nigeria President for 2019

Wia dis foto come from, PHILIP OJISUA
Di President of Nigeria Senate, Dr. Bukola Saraki, don bring imself come front, say im wan be president of di kontri for 2019.
Im tok im mind as im dey tok wit youth groups for Abuja dis afternoon. E neva tey wey oga Saraki port from di ruling All Progressives Congress (APC) go di main opposition People's Democratic Party (PDP).
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2
Na for di first edition of di Public Dialogue Series with Political Parties on Youth Candidacy and Party Primaries for Abuja, im tok am.
Di Senate President say many pikin dem for Nigeria dey hungry and say disease wey dem fit treat dey kill dem.
Im say: "Di necessary education facilities and system to equip dem for di future no dey. We no dey create di jobs wey fit grow our economy. And dem no dey consult youths as dis kontri dey take waka", im tok.
Saraki say Nigeria economy don pafuka, say unemployment high well-well, say bizness dey close.
All di tins wey im tok plenti well-well including how im take tok say di kontri don divide pass as e dey before.
"We must make sure say lives dey secure for Nigeria. As things stand now, nobody dey safe for dis kontri...we must rebuild di trust of our pipo for goment," im tok
End of Di one wey oda users dey read well well
As Saraki don declare now, im don join odas wey don declare to be president under PDP party. Dia names na:
- Atiku Abubakar
- Rabiu Musa Kwankwaso
- Bukola Saraki
- Ahmed Makarfi
- Ibrahim Shekarau
- Datti Baba Ahmed
- Sule Lamido
- Jonah Jang
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3