You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Police dey find driver of fuel tanker fire for Port Harcourt
Police dey find di driver of di petrol tanker wey catch fire Thursday early morning come burn down many shops, event centre and church for Port Harcourt, southern Nigeria.
Pipo wey carri eye see wetin happun tell BBC News Pidgin say di tanker driver loss control as e dey drive along Eliozu Express road around 5am before e fall down begin catch fire.
Nobodi don see di driver, eyewitness tok. Rescue operations dey go on, so far no body don die but dem don block traffic for dat part of Port Harcourt.
According to Raphael Anorue wey dey drive motor along di Eliozu road see wetin happun, im say 'as di tanker jam electric pole come fall di sparks from di pole na im start di fire'.
We tori pesin wey dey on ground see photo wetin happun.