INEC PVC Deadline: Wen Voters Registration go end?

Nigeria 2019 Election: Wen Voters Registration go end

Wia dis foto come from, Twitter/@inecnigeria

Wetin we call dis foto, Now na 87,578,726 be di number of registered voters and any pesin wey miss Friday deadline don miss 2019 election.
Read am in 1 mins

Nigeria pipo wey don pass 18 years of age get until 5pm on Friday 31 August to register as voter for 2019 general election, according to latest informate wey Nigeria election office INEC announce.

Tori be say as at January 2018, INEC don record 73,944,312 voters and dem bin dey target at least 80 million registered voters before December 2018 ,di final-final deadline for any mata wey concern voter registration.

INEC on Wednesday announce say since January 2018, di new pipo wey don register to get voters card inside di Continues Voter Registration don reach 13,634,414 pipo.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Di election office say say inside dat number, 7.3 million be women, while 6.2 million na men.

And na only over 800 thousand pipo don get di Permanent Voters Card.

E remain at least 169 Days before di Nigeria 2019 general election

Wia dis foto come from, Twitter/@inecnigeria

Wetin we call dis foto, E remain at least 169 Days before di Nigeria 2019 general election

INEC on 14 August add extra two weeks join di last deadline but still di crowd wey full registration centre no be here.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

As e be so, INEC don meet dia December 2018 target to register at least 80 million voters for di 2019 election. Now na 87,578,726 be di number of registered voters and any pesin wey miss Friday deadline don miss 2019 election.