Osun-Osogbo Festival: Di god wey dey give pikin don land
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Pipo don dey joli Osun-Oshogbo Festival since before 1950s even UNESCO wey be United Nations office on top culture mata don make am heritage site.
Osun-Oshogbo Festival for 2018 begin on Friday wit plenti tourists, pipo wey go see wetin dey happun and traditional worshippers full ground dey joli for dia.
Di festival na wetin Osun pipo for southwest Nigeria dey use celebrate di god wey dey give pikin.