You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
AFCON 2019: Ghana don release 23 man squad list but dia ogbonge players dey miss
Ghana on Friday release list of 23 man squad wey go face Kenya for 8 September 2019 Africa Cup of Nations qualifier.
Abedi Pele Ayew children André Ayew and im brodas Jordan Ayew, Imani Ayew and Ibrahim Ayew no make di list.
Inter Milan Midfielder Kwadwo Asamoah follow for ogbonge names wey dey di list but Asamoah Gyan name no dey inside.
Harambee stars go host Black stars of Ghana Kasarani Stadium Kenya next month.
See di full list:
Goalkeepers: Richard Ofori, Lawrence Ati Zigi,
Defenders: Andy Kyere Yiadom, Rashid Sumaila, Daniel Amartey, Nicholas Opoku, Kasim Nuhu, Joseph Aidoo and Lumor
Midfielders: Kwadwo Asamoah, Nana Ampomah, Christian Atsu, Afriyie Acquah, Alfred Joseph Duncan, Thomas Partey, Edwin Gyasi, Obeng Reagan, Ernest Ohemeng, Isaac Sackey.
Strikers: Kwasi Okyere Wreidt, Raphael Dwamena, Frank Acheampong, and Emmanuel Boateng
End of Di one wey oda users dey read well well
Cameroun go host di first African nations cup wey dem go play for June and July, na for January dem dey play di oda ones.
16 kontris bin dey play di nations cup but CAF say na 24 kontris go play di next one.