You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Airline mechanic don crash plane, e fly witout permission from airport
One airline mechanic wey go cari empty passenger plane from Seattle airport don crash di plane for one island.
Di mechanic tiff di Alaska Airlines plane wey no passenger dey inside and take off. Dis force Seattle-Tacoma International Airport to close.
According to wetin di Pierce County Sheriff Department tok for Twitter, di first informate wey dey dem get suggest say di mechanic tiff di Horizon Air Q400 and di crash happun because di pesin dey "do stunts for air or e no get flying skills."
Eye witness tok say two F15 fighter jets pursue di plane.
E no dey clear if di man survive di crash for Puget Sound.
Airport officials say di airline mechanic "do unauthorised takeoff witout passengers".
One recording wey dem share online reveal say Air traffic controllers try to encourage di man to land before di plane crash.
For di audio recording, dem hear di man as e begin to worry about how much fuel dey di plane. E also suggests say e go fit land di plane by imsef because e play "some video games".
End of Di one wey oda users dey read well well
Horizon Air na part of Alaska Air Group and dey fly short routes throughout di US West.
Di Q400 na turboprop aircraft wit 76 seats.