Kidnap suspect wey take tramadol come sleep for six days fit die - Doctor

Tramadol

Wia dis foto come from, Google

Wetin we call dis foto, Pipo dey abuse drugs like tramadol and codeine well-well for Nigeria

One suspect wey bin wan kidnap one pharmacy owner but sleep off because of tramadol wey im take, fit die for im sleep.

Dis na wetin doctor tell BBC Pidgin, afta police tok say di suspect still dey sleep six days afta dem arrest am.

Dr Kunle Obilade from Adeoyo state hospital, Ibadan, Oyo State tell BBC Pidgin say di suspect fit still survive even as e neva chop for 6 days and also say e fit still die.

Im say: "E possible say e fit survive if dem cari am go hospital and e possible say e fit no survive because di drug dey powerful and e go don do plenti damage for im bodi plus say e neva chop and drink water.

"If dem take am go hospital, doctors fit pass water enta im bodi. Di water go also stand as food to sustain am for some time."

Dr Kunle say di tramadol still fit kill am upon di water wey hospital go pass enta di bodi because di drugs dey scata tins for di bodi and dey affect di brain plus di pipe wey dey control breathing.

Police say dem see 400mg tablet of tramadol inside di pocket of di sleeping suspect

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Police say dem see 400mg tablet of tramadol inside di pocket of di sleeping suspect

Police men for Ondo State, south west Nigeria bin arrest di suspect last Sunday as im and three oda members of im gang go di pharmacy shop for Owo town inside di state to try kidnap di owner.

Tori be say di man sleep off for victim house on 5 August, afta im take tramadol wen im go to operate.

Ondo State police public relations officer, Femi Joseph tell BBC News Pidgin say dem don cari di suspect go hospital to make sure dem give am proper medication so dat e go help di police wit dia investigation.

"As at Friday we neva fit still get any statement from am but we no wan take any chances, we dey take good care of am to make sure say e wake up so dat e go tok to us."

Oga Joseph say doctor still dey attend to di suspect because e be like say e take plenti of di dangerous drugs wey be tramadol.

E add say dis na wetin all dis criminals dey take anytime wey dem wan go for operation but dis one back fire for dis kidnapper because e no get di opportunity to do exercise wella afta e take am inside bodi.

"We sabi say afta some time, di tramadol go comot from im bodi and we go dey able to tok to am," im tok.