Mortuary wonderment wia plenti deadi bodi miss road

Funeral dey happen for Kenya

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Imagin say dis no be di right pesin

Wahala wear brazier for mortuary afta tori break say dem cari deadi bodi give ova six families to go bury.

Dem notice di mistake afta one family bin go to collect di deadi bodi of dem relative but no see am for di mortuary.

Di mata hot sotay di mortuary officials come ask six families wey dem bin release deadi bodi to return dem back.

Stephen Mburu family wey bin dey plan to bury am on Tuesday, August 7, come to collect di bodi dem bin deposit on 1 August. but dem no see di deadi bodi again o.

Burial for Kenya

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One family even dig comot who dem bury afta di mix up

Now four families bring dia dead bodi by Tuesday 7 August, 2018. In fact, dem need to dig one wey dem bin don alredy bury.

E happun for one Kenya mortuary wey be Kiambu Level Five Hospital and na all di male deadi bodi dem bin release on August 7 na im e affect.