Meet di man wey be friend with deadi bodi
Death na wetin all man go face last last.
So BBC Pidgin Daniel Semeniworima spend one day for cemetery with Dehinde Harrison wey don dey take care of deadi bodi for 32 years now.
Harrison talk how im dey enjoy life for grave yard so tey im say "deadi bodi dem dey friendly with me."
Im also share how im dey plan how pipo go arrange dia burial before dem die.
