'I dey hide inside coffin as pickin' - Di woman wey dey sell coffin

Wetin we call dis Video, 'Person wey no fit talk no get power over you' - Meet di woman wey dey sell coffin

Bolanle Okusanya don waka where her papa, and her grandpapa bin don go before her; she dey bury dead bodi.

Her clients dem na from different level for society; na she do di burial for famous Nigerian footballer Stephen Keshi.

She follow BBC News Pidgin talk about di business and how she don turn wetin most pipo dey run from, into her daily bread.