Ghana President announce en first ministerial reshuffle

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana President Nana Akufo-Addo announce en first ministerial reshuffle since he start chop power, 2017.
Di press statement which dem release Thursday evening wey Director of Communications Eugene Arhin sign, dem talk say di changes dey take place plus immediate effect.
Di reshuffle wey happen affect fifteen ministers, most of whom he reassign go another ministry.








