Special Adivser on Graveyards: I resign because Ganduje break im promise

Yakubu Alhajiji Nagoda
    • Author, Mansur Abubakar
    • Role, BBC News Pidgin, Kano

Yakubu Alhajiji Nagoda, wey bin dey work as Special Adviser to di Kano State Govnor on top graveyard mata don tok say di govnor break all di promise wey im promise.

Oga Nagoda tell BBC News Pidgin say Governor Abdullahi Umar Ganduje no follow di roadmap wey dia movement, Kwankwasiyya, bin arrange and wey di goment suppose dey follow.

E say di govnor and all di oda pipo under former govnor, Rabiu Kwankwaso, dey inside di group but Govnor Ganduje don forget di tins wey di group agree to do for di state.

"We dey remind am evriday but e no dey respond. Dat na why I resign."

Wetin we call dis Video, How some pipo react wen Kano Deputy Govnor port

Oga Nagoda say im bin dey do double work as special adviser.

"Di first tin na to always remind di govnor say e dey important to dey keep promise because, at di end, na grave all of us dey go."

E say di second tin na to repair di graves.