Apple break $1 trillion record

Apple di makers of iPhone and Mac computers on Thursday become di first public company in di world wey go worth $1 trillion. Dat na $1,000,000,000,000!

Since di company first become public for 1980, Apple shares don rise more than 50,000%.

Di market capitalisation of di iPhone maker reach dat amount dis afternoon inside trading for New York as dia share rise pass $207.

Apple beat Silicon Valley rivals like Amazon and Microsoft to become di first to reach di $1 trillion value.

Na since Tuesday di stock don increase by 9% when tori comot say Apple sell market well well from April to June.

Apple stock don rise more than 50,000% since dem first become public company in 1980.

Steve Jobs wey be one di founders of Apple, create di iPhone, wey come ginger di worth of di company to wetin e be today. For 2011, Jobs die from sickness and Tim Cook come replace am as company oga.