You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Codeine cough syrup: Nigeria customs gbab illegal codeine cough syrup wey reach 200 million
Nigeria Customs for Lagos don seize 498 cartons of illegal Codeine cough syrup wey e cost reach up to 200 million naira.
Na for Ijebu Ode-Ore road for Ogun state di men of di Nigeria Customs bin gbab di shipment enta di kontri from di United Kingdom.
Mohammed Uba wey be oga for Customs tell tori pipo say dem don arrest and detain two pipo wey dem suspect get hand inside di bad business.
Uba tok say, ''Una go remember say, goment don ban di import of cough syrup wey get Codeine ingredient inside am.''
''We go hand over di drugs and suspects to NAFDAC, so dem fit continue di investigate and cari di case go court, wen di time reach.''