Bukola Saraki, Kwankwaso, Buhari and Olisa Metuh: Di foto you no suppose miss from Nigeria Tuesday drama

Tuesday 24 June 2018, na one wey many pipo no go quick forget for Nigeria.

Di main di main wey happun by di time sun set na say 14 members of di ruling All Progressives Congress for di kontri Senate and 38 members of di House of Representatives port comot for di party.

Di whole action on Tuesday happun fast fast like action feem, so you fit don miss some part.

Here na some of di foto dem wey you no suppose miss.