How Universal Music wey come Nigeria go take help upcoming musicians

Read am in 1 mins

As Universal Music Group don open new division for Nigeria, musicians don dey tink as e go use benefit dem.

One upcoming musician, David Oluwilliams tok say e beta as as e go help Nigerian Music.

E say "di way wey dem go fit help our music na if dem sign new artistes.

"E beta say dem don land for Nigeria because e go help dem get di personal feel of di musicians," im tok.

Pipo for social media don already dey chook mouth for di mata.

Dis new division wey Universal Music Group open go be di third dem go open for Africa.

Dem announce di opening for dem website, say e go also promote music from Ghana and Gambia.

Dem don already sign Nigerian artists like Mr Eazi and Tekno and Stonebwoy from Ghana.