Ghana cedi dey fall like 'mango' against US Dollar, minority predict worse by end of year

Ghana cedi

Wia dis foto come from, Ghana Central Bank

Wetin we call dis foto, Dis be old Ghana cedi currency wey Ghana dey use before-before
Read am in 1 mins

Di Ghana cedi dey fall ground like 'mango' against di US Dollars after e drop catch at Gh¢4.85 to one dollar.

Di cedi which start dey fall around May reach all time low under di Akufo-Addo government.

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

Minority for Parliament caution government say make dem hold di cedi soon else e fit drop further pass Gh¢5.1 to one dollar.

Businesses start dey panic sake of di fear say di depreciation price of goods den services like housing, fuel prices, imports like food den spare parts go go up as s dem dey exchange cedi for dollar.

Meanwhile Minority say make Vice President Dr Bawumia lock di cedi like he claim last year.