French Minister get gunshot welcome for Buea for Southwest region

Jean-Baptiste Lemoyne

Wia dis foto come from, Yannick Fonki

Wetin we call dis foto, French Minister for Europe and Foreign Affairs Jean-Baptiste Lemoyne
    • Author, Leocadia Bongben
    • Role, BBC News Pidgin, Cameroon
  • Read am in 1 mins

Jean Baptiste Lemoyne French Minister of State wey dey attached to di Ministry for Europe and Foreign Affairs visit Buea even as secessionists dem warn before say deh no wan see e, den deh welcome e with gunshots.

Resident for Buea tell BBC News Pidgin say Ambazonia fighters pass for Mile 16 around de taim weh French Minister e convoy bi di pass.

"As deh boys dem di pass for Mile 16, na only gunshots we hear, all man bi di run for e life, business pipo abandon dia goods, deh kill two police for de area, but today all place be calm", de resident tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Dia shooting force all man for town for hide and de town die for some taim, and tori say deh shoot, wound one Bensikin man for Mile 18.

With dia ngrimba, 'Odehsi' some pipo weh witness gun exchange say as army di shoot bullet no di enta for the Ambazonia fighters dia skin.

Before de French Minister e visit secessionist bin warn say deh no wan see e for Buea, deh accuse France say deh di join hand with La Republic.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Before French Minister go Buea for tok with authorities and traditional rulers, NGOs and oda groups, e first meet President Paul Biya and deh tok Anglophone crisis plus oda issues dem.

Buea no be de only place weh gun fire bi dey for kontri as for Mbengwi side for Northwest region Ambazonia fighters attack army moto and for de shooting deh kill one army man, wound five odas and also kill six Ambazonia fighters.