Tanker explosion for Lagos don kill nine pipo, finish 54 cars

Wetin we call dis Video, Pipo bin dey follow di tanker do bumper to bumper
Read am in 1 mins

Nigeria FRSC don confam say nine pipo die and 54 moto burn for di tanker explosion wey happen for Lagos-Ibadan express way.

Di Federal Road Safety Command (FRSC) Lagos state commander Hyginus Omeje confam wetin happun to BBC news Pidgin say, nine pipo burn sotey dem no fit recognise dem again.

Our tori pesin Dan Ikpoyi wey dey ground say, authorities dey try clear di area.

Di tanker explosion happun for Otedola bridge near Berger for Lagos south west Nigeria.

Omeje say, di way dem see di mata be say di driver lose control of di tanker.

Sate officials dey ground to fight di fire and help pipo
Wetin we call dis foto, Sate officials dey ground to fight di fire and help pipo

Lagos State Traffic Management Authority (LASEMA) bin first confam di mata and pipo dey share foto for social media.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Some of di vehicles wey burn
Wetin we call dis foto, Some of di vehicles wey burn